Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profileg
Daily Devotional

@streetchurchh

The gospel according to the street. https://t.co/NB7iNcmYgv

ID:1363898115141599234

linkhttps://linktr.ee/streetchurchh calendar_today22-02-2021 17:07:25

6,8K Tweets

197,8K Followers

58 Following

Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

Some of us dey live life like the isrealites did in this passage. Dem go dey make peace with people wey dem suppose no associate with and dey no even bother to ask God about it.

Any decision wey we won make for life no matter how small, we suppose ask God about it. He knows more

Some of us dey live life like the isrealites did in this passage. Dem go dey make peace with people wey dem suppose no associate with and dey no even bother to ask God about it. Any decision wey we won make for life no matter how small, we suppose ask God about it. He knows more
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

God talk say he go bless the work of your hands, e mean say he go bless your enterprise, your hardwork. God go bless your doings, no be by tappings!

No base your blessings on wishful thinking & permutations! Bible say “Isaac sowed in the land”, e no dey tap land o. Get to work &

God talk say he go bless the work of your hands, e mean say he go bless your enterprise, your hardwork. God go bless your doings, no be by tappings! No base your blessings on wishful thinking & permutations! Bible say “Isaac sowed in the land”, e no dey tap land o. Get to work &
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

Children are wonderful blessing from God. Congratulations to those wey get dem and I pray for those wey dey expect their own bundle of joy, God go do am for you.

Happy Children’s Day!

Children are wonderful blessing from God. Congratulations to those wey get dem and I pray for those wey dey expect their own bundle of joy, God go do am for you. Happy Children’s Day!
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

When you think about everything wey God don do in your life, you go dance like say no tomorrow.

People fit dey wonder say wetin dey worry this one? But you no go mind dem bcos na you sabi wetin God don do for you.

Make sure say you dance well well for church today.

When you think about everything wey God don do in your life, you go dance like say no tomorrow. People fit dey wonder say wetin dey worry this one? But you no go mind dem bcos na you sabi wetin God don do for you. Make sure say you dance well well for church today.
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

As child of God, when devil come whisper some of him lies for your ears, sharply block am. No allow anything wey e talk enter your mind.

If you no gree for am, he go run away. Make you stand gidigba on wetin God don tell you about your life.

As child of God, when devil come whisper some of him lies for your ears, sharply block am. No allow anything wey e talk enter your mind. If you no gree for am, he go run away. Make you stand gidigba on wetin God don tell you about your life.
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

We love to see people rock @streetchurchurban 🥰🥰😍😍🥰

Where are our fine boys and girls wey love Jesus?!
Shop am on 🔗 streetchurch.bumpa.shop now!

Urban


We love to see people rock @streetchurchurban 🥰🥰😍😍🥰 Where are our fine boys and girls wey love Jesus?! Shop am on 🔗 streetchurch.bumpa.shop now! #StreetChurchUrban #Merchandize #StreetChurch #FineBoysWeyLoveJesus #FineGirlsWeyLoveJesus
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

Some of us don trust people and na dose same people come stab you for back. Bcos of that, you still dey carry the pain and hurt everywhere you go. E come hard you to trust anybody again.

My prayer be say God go heal your broken heart and e go connect you with right people. Amen

Some of us don trust people and na dose same people come stab you for back. Bcos of that, you still dey carry the pain and hurt everywhere you go. E come hard you to trust anybody again. My prayer be say God go heal your broken heart and e go connect you with right people. Amen
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

If you dey do good but e come be like say you just dey waste your time bcos you no dey see result, God’s word to you be say make you no give up.

God no Dey owe person na humans dey do that. Continue in that part and he will surely reward your efforts.

If you dey do good but e come be like say you just dey waste your time bcos you no dey see result, God’s word to you be say make you no give up. God no Dey owe person na humans dey do that. Continue in that part and he will surely reward your efforts.
account_circle
Daily Devotional(@streetchurchh) 's Twitter Profile Photo

We thank God say belle no be show glass wey go make people dey laugh us when things no too dey.

But we know for sure say, e no go last forever. Better days go come and belle go full. Amen

We thank God say belle no be show glass wey go make people dey laugh us when things no too dey. But we know for sure say, e no go last forever. Better days go come and belle go full. Amen
account_circle